obodo oyinbo

 Iran Drop Revenge List, Name US, Israel Leaders

todayJuly 12, 2026 11 12

Background
share close

Edited by Ebi Oboko

One Iran newspaper wey dem dey call,  Hamshahri, don release  list of 13 foreign leaders wey Iran dey plan  revenge for di kpaing of former Supreme Leader Ali Khamenei.

Di list include leaders from United States, Israel and some European countries, an dis one comout late  Saturday.

Khamenei son and successor, Mojtaba Khamenei, vow say revenge must happen, saying those wey dey on di list no go enjoy peaceful death.

Di threat come after US and Israel strikes reportedly kpai Ali Khamenei on February 28, di first day of di Middle East war.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds