obodo oyinbo

Iran Threaten To Fire America And Israel

todayJune 8, 2026 8

Background
share close

Iran don threat say dem go drop tins for America and Israel sake of bombing wey hapun for Beirut on Sunday, as di Middle East war clock exactly 100 days.

Dis new round of wahala dey spoil tins, di hope say, peace go soon come, don jam rock like dis.

Tehran clear everybodi, say any peace tuk to end di war permanently must also stop di fight inside Lebanon, wia Israel dey pursue Hezbollah fighters wey Iran dey support.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds