By: Esther Ayoola
Israel military don carry out some wicked air strikes for southern Lebanon, even reach areas wey dem call “Yellow Line”.
According to report, One of di strikes kpai five pipo, including three civil defence workers wey dey try rescue pipo from earlier attack, and two Lebanese soldiers sti get wunjury.
Lebanon Prime Minister Nawaf Salam don condemn di attack, call am war crime, and say dem go try push to see say, di ceasefire between di two both countries dey respected.