By: Esther Ayoola
Justice Mohammed Umar for Federal High Court Abuja omo cut chain on Monday for Omoyele Sowore lawyer, Marshall Abubakar, for court because say e tuk anyhow for court.
Judge even tell am make e comot come kneel down for front of everybody.
Say Abubakar raise hin voice for court say, date wey dem fix nor favour, di tin vex judge.
Other lawyers con manage calm di judge down, while Sowore dey face case from DSS for say e tuk say Presido, Bola Tinubu na criminal for X and Facebook.