By: Esther Ayoola
Governor Agbu Kefas of Taraba State don praise the outgoing oga dem for security agencies for the good work wey dem do for the state, say their performance na correct one.
Di govo tuk this one during one state dinner for Gornment House Banquet Hall for Jalingo, wey dem organize to honour security chiefs wey retire or transfer comot from the state.
Im still reassure pipo say im gornment nor go relax for mata of insecurity whether pipo comot or not,and dat e get Taraba na di most peaceful state for di obodo Naija