OBODO NAIJA

Keke Union Worker Kpai As Ticket Marras Turn Fight For Taraba

todayJuly 30, 2026 9

Background
share close

Taraba State Police don grab two suspects after dem allegedly stab one Keke union ticket collector kpai for Angwan Kassa Junction, Jalingo, on Wednesday, as fight over daily union ticket scatter everywhere.

Tori be say di union worker stop one Keke rider wey no buy di compulsory ticket, and as argument hot, one person pull knife stab am.

Di man later die from di injuries, and fear grip residents and commuters as people run comot for di area.

Police spokesperson, ASP Victor Mshelizah, say dem don arrest two suspects and investigation still dey go on before dem charge dem go court.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds