OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Blow Whistle On Top Peter Obi Head

todayJune 10, 2026 9 2 5

Background
share close

Popular Nollywoord Actor, Kenneth Okonkwo don come out clear marras say, he get duty to report any crime against di state wey come to him knowledge and that South-East pipo don too suffer.

He yarn dis one for him X social media page on Wednesday say, no person suppose still dey take dem or any Nigerian citizen play or carry out wayo wayo without challenge.

He say, Obunike na just one among many others wey dem allegedly scam through NDC and dia ogas, and dat di proper security and anti-corruption agencies suppose touch light dis wayo wayo sharpaly  wey di NDC and dia ogas dey run.

According to Obunike Ohaegbu, Peter Obi dey among di pipo wey NDC allegedly talk say get hand for di marras, and dem gats to touch light him frequency.

 

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

OBODO NAIJA

Obi Lawyers Drag Kenneth Okonkwo, Demand N5bn

Nor be small thin oh, as two best frens don turn enemies, say like dis, di Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, NDC, Peter Obi, don tell im lawyers say make dem drag former actor- wey turn-politician Kenneth Okonkwo to pay N5 billion damage dat im spoil im name for […]

todayJune 10, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds