By: Rilwan Agbomeji
East Africa no wan gree leave throne for Lagos City Marathon as Kenya and Ethiopia scatter everywhere for 2026 edition. Kenya Ezra Kipchumba Kerin blaze di road finish 2 hours, 11 minutes, 55 seconds take carry men title, while Ethiopia Meseret Dinke storm di women race finish 2:37:36 for Eko Atlantic.
Rain fall small but race still burst 6:30am from Orca Mall, 42km warriors grind am out while crowd line Atlantic side dey shout fire for di runners. Organisers hail di marathon as one of Africa baddest road races with heavy prize money of $50,000 to di winner, as gorment and sponsors promise say Nigeria sef fit rise challenge if dem train and invest well.
Top oga dem like Shehu Dikko from National Sports Commission and Lagos Deputy Governor Obafemi Hamzat salute di race success well-well, say e clean and world-class. Dem urge young people make dem stop sidon dey complain but come out participate, as dem talk say with serious training and better support, Nigerian runners fit soon break East Africa stronghold for di marathon scene.