By: Rilwan Agbomeji
Fresh gbege don sup for Kano say Former Govnor Rabiu Kwankwaso tell members of New Nigeria People’s Party (NNPP) make dem pledge loyalty to reinstated Emir of Kano, Lamido Sanusi.
Dis one no sit well with deposed Emir, Aminu Ado-Bayero, as e quickly fire back.
U sabi say, On 23 May 2024, Kano State Governor, Abba Yusuf, remove Ado-Bayero as Emir afta State House of Assembly cancel di 2019 Emirate Council Law wey former Govnor Abdullahi Ganduje put in place.
Afta dem cancel di law, government bring back Sanusi as di only Emir of Kano.