By: Mariam Ajayi
La Liga president, Javier Tebas, say Manchester City suppose face di most severe sanction available if dem breach financial regulations.
Reports on Friday claim say one independent panel find City guilty of almost all of di 115 charges wey dem face for breaking Premier League rules.
But Premier League never officially announce di finding or any punishment, and e never clear wetin sanction City fit face.
City, wey Abu Dhabi back, don always deny di charges, while Chairman Khaldoon Al Mubarak maintain say di club go eventually prove say dem no guilty.