By : Jolayemi Olajide
Lagos State APC don formally announce di party state Deputy Woman Leader, Princess Damilola James, as di running mate to dem gofnorship candidate, Dr. Obafemi Hamzat, ahead of di 2027 election.
Oga Lagos APC Chairmo, Cornelius Ojelabi, naim break di news inside statement on Monday, revealing say di choice of di Badagry-born princess, na based on agreement wey di house agree.
Ojelabi hail madam Damilola, say she get solid doins, leadership power, and strong grassroots background wey go match Hamzat experience to carry Lagos go next level.
Indigenes of Badagry and APC supporters don already start to juburate on top di selection, as dem feel say her presence go give di ticket better edge for di forthcoming guber race.