By: Esther Ayoola
Lagos High Court for Tafawa Balewa Square don order Meta Platforms Inc. make dem pay Senior lawyer, Femi Falana SAN twenty-five thousand dollars say dem go put hand for im mata without permission.
U sabi say, Falana go complain to court, say Meta publish video and voice message wey claim say e get prostate sickness, and say dat one na im private life, and for naija law, no body suppose enter person private life.
Justice Olalekan Oresanya tuk say big tech company like Meta Suppose protect people from bad content wey dey dia platform.
Court still base di judgment on Nigeria Data Protection Act and Fundamental Rights rules, and Meta Dey Guilty, so therefore must pay for damages.