Lagos

Lagos Dey Redefine Agriculture As Engine For Growth, Sustainability – Sanwo-Olu

todayOctober 17, 2025 3

Background
share close

Govnor Babajide Olusola Sanwo-Olu don yan say him administration dey fully committed to turn agriculture into strong engine wey go bring growth, carry everybody along, and keep things sustainable. E talk dis one on Thursday for di 2025 World Food Day celebration wey happen for Police College, Ikeja. Di theme na “Hand in Hand for Better Foods and a Better Future.” Sanwo-Olu, wey Barrister Bimbola Salu-Hundeyin, di Secretary to di State Government represent, talk say agric na di backbone of Nigeria economy — e dey help people survive, push innovation and support better life. E add say di World Food Day na reminder say everybody get role to play to strengthen Lagos food system and fight hunger and malnutrition.

Sanwo-Olu talk say di theme of dis year celebration show say everybody, government, private sector, NGOs, and communities,  must join hand to change how we produce food, chop better, and protect di environment. E talk say Lagos get unique challenge, as di smallest state in land but with over 22 million people, so dem need bold ideas, heavy investment and strong partnership to feed di people. E remind say di state launch Five-Year Agric Roadmap in 2021, to boost food self-sufficiency from 20% to 40% by 2025, and since then, plenty projects don land to help farmers and youth, stop waste after harvest and link them to market. Abisola Olusanya, Commissioner for Agric, still add say di state don invest big into agric and protect land for farming. Highlights of di event include brand new N15m truck gift to Most Beautiful Farmer, Oluwaseun Evelyn, plus awards to top farmers: Farm Junction win best Agro processor; Erikorodo Poultry Estate win best farm estate; Ajara win best farm settlement; Lagos Island win best livestock champion; Apapa win best aquaculture; Ejalonibu fishermen group win best artisanal champion; Yaba win best LGA/LCDA and Daddy Lewis Tomato Growers, Badagry carry best crop champion.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app