By: Esther Ayoola
Ogun State Gornment say, one doctor from Lagos don land prison dat, im go give fake medical report to hellep internet personality, Adetoun Onajobi, aka @justadetoun, Say e wan bin save her from police arrest.
State Attorney General, Oluwasina Ogungbade, SAN, confirm di tori for statement wey dem share for X.
From report, dem dey accuse Adetoun of plenty oppression and di use of bad language online and spead of fake news.
Say her faawooo lay cook egg, when Adetoun go post about former boxing champion, Anthony Joshua, afta di accident for Ogun State.
Di Attorney General say dis internet tuk tuk, release videos alleging dat, Ogun gorment nor send emergency ambulance, accusing di govo, Dapo Abiodun, say im nor care about pipo safety.