By: Esther Ayoola
Lagos State gorment don drop ogbonge update dat, second round of polio vaccination for childrenses go start from Saturday, December 6 to Tuesday, December 9, 2025.
Di campaign say na Lagos State Primary Health Care Board with National Primary Health Care Development Agency, WHO, UNICEF and other partners dey run am to stop polio.
Gorment talk say na follow-up after November 8, 2025 first phase, wey dem start after dem detect orphan circulating Variant Poliovirus Type Two for Makoko, Lagos Mainland.
Dem warn say na part of ongoing fight to protect children, boost immunity, and make sure polio no scatter for di state again.