Local

Lagos Go Invest Over ₦5b For Next Phase Of NYSC Permanent Orientation Camp.

todayOctober 3, 2025 3

Background
share close

Governor Babajide Sanwo-Olu don talk say Lagos State go put extra ₦5 billion for next phase to build di State 10,000-capacity National Youth Service Corps (NYSC) Permanent Orientation Camp for Agbowa, Ikorodu. Sanwo-Olu yan dis one for meeting wey e get with NYSC Director General, Brigadier General Olakunle Nafiu, for im office. Sanwo-Olu hail Corps Members for wetin dem don do for Lagos development, call NYSC programme national pride. E talk say all participants suppose wear di experience with dignity and honour. Di Governor come still talk say as Government, Lagos State dey responsible and dey respond to di needs of di Scheme.
Sanwo-Olu come promise say e go look into NYSC request for ambulance and other equipment wey go make di Scheme work better for Lagos State. Di governor talk say di minimum allowance for Corps Members wey dey serve for Lagos government agencies don increase to match how economy be now. E talk say Lagos go still dey support NYSC and give better environment wey Corps members go dey feel wanted, loved, and enjoy dia service year well well.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app