By: Mariam Ajayi
Lagos State Gornment don begin toast lagos youths wey dey between 18 and 26 years say make dem join military sake of say di state need meet dia recruitment quota.
Say dis nor be to look and thruway face like say insecurity nor concern youth, dat naija reallyneed beta collabo and energy to battle insecurity.
Senior man Seco to di Gornment, Abimbola Salu-Hundeyin, naim drop dis micro soft word during meeting with local gornment secretaries and Police Community Relations Committee people.
She porporly matas say youth not being part of di naija military doings nor really make brain as di country really need fresh energy to battle insecurity.