By: Rilwan Agbomeji
Oga Chairmo of Lagos State Internal Revenue Service (LIRS), Dr. Ayodele Subair, don clear mata say, dem nor dey debit any company account directly if dem never pay tax.
E yarn dis one for tv sit don tuk, say LIRS just wan collect unpaid tax from companies to fit provide beta things for Lagos.
Subair explain say, nobodi go impose tax on person or companies wey dem nor suppose pay, and dat anybody fit contest tax wey dem feel say dem nor suppose pay.
E still make am clear say LIRS no dey rush to enforce di new tax law, but dem dey hope make pipo and companies cooperate with dem.