By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment say, dem go partially close Lagos–Abeokuta Expressway for four weeks.
According to di Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, di closure go start from today Wednesday, February 11, make Federal Ministry of Works fit repair some bad portions of di road.
Di repair work go cover di stretch from U-Turn Bus Stop reach Sango Tollgate.
Both pipo wey dey go Lagos side and those wey dey go Abeokuta side go dey affected cause of di half closure