By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment say, dem dey serious about inclusive housing development, and say dem dey put do correct doings for pipo wey get disability for all housing projects for state.
Na Permanent Secretary for Lagos State Ministry of Housing, Abdul-Afeez Toriola, tuk dis one when officials from Lagos State Office for Disability Affairs visit dia office.
Toriola say, ministry don dey include special provisions for pipo wey get disability for dia housing estates, and dem dey follow proper guidelines to make sure everywhere dey accessible.
E sti tuk say ministry ready to do more work to fix any gap, so dat everybody fit get equal chance to enjoy housing for di state.