By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don repeat tuk,say dem go continue to improve and strengthen drainage system for across di state.
Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one, when e tuk to journalists afta e go inspect different drainage projects wey dey on.
Oga environmental commissioner say di heavy rain wey fall for dis new year don show say climate change and global warming get big plans for Lagos, so therefore na to prepare be di way forward.
E say, like dis, dem hear report from whistleblower about pipo, wey dey block System 46 drainage, na why, dem go check di area, say dat kind doings nor good at all.