By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment say now, dem wan to dey use surveillance drones to boost security work across di state.
Executive Secretary of Lagos State Security Trust Fund, Ayodele Ogunsan, ni dey tuk dis one during press conference to mark him first 100 days for office.
According to am, dem dey plan sign agreement with Nigerian Air Force and Naija Police Airwing to support beta aerial monitoring and faster response to threats.
Ogunsan press tuks say, as Lagos be Naija commercial centre, e suppose get ogbonge security, ni make dem dey buy di waka.