Lagos

Lagos Gornment Ban Heavy Load For Danfo

todayMay 20, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State gornment don announce ban on movement of goods and heavy luggage for danfo across di state.

Na di Lagos Metropolitan Area Transport Authority dey tuk dis one for statement wey dia Head of Corporate Communication, Kolawole Ojelabi, release on Tuesday.

Dem say di enforcement go start from June 1, 2026, and e go affect buses wey dey carry passengers for public transport system.

Dem explain say di decision na based on say some pipo dey complain how ampit odour and mess wan finish dem for danfo cause of overload.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds