Lagos

Lagos Gornment kramp Man Wey Dump Dirty for Drainage

todayJuly 15, 2026 9 1

Background
share close

BY Esther Daniel

Lagos State Gornment don arrest one 56-year-old man, John Ehidreme, say im allegedly go thruway dirty for gutter for No. 18 Oluoga, Ikorodu.

Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say officials catch the man on Tuesday as government dey step up enforcement of environmental sanitation laws.

The arrest come after one video spread online wey show one security guard dey pour refuse from dustbin enter drainage for Ikorodu.

Government don warn residents make dem stop to dey dump dirty inside gutter, say anybody wey break environmental laws go face the law

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds