Lagos State Government don launch one new digital platform wey dem call Lagos Emergency Responder Management System (LERMS),
Dis new system go make all emergency agencies to join bodi and respond to emergencies anywhere gbege happen.
For statement wey gornment release, dem talk say dem unveil am for Folarin Coker Staff Clinic Conference Hall for Alausa, Ikeja.
For di launch, Commissioner for Special Duties and Inter-Governmental Relations, Gbenga Oyerinde, tuk say dis move na to ginger safety for Lagos and to ensure say response no dey slow again.