Lagos State Gornment don announce say dem kpake over 270 million naira from di hand of 419 estate agents and house developers to give di owners wey dem cheat.
Di Commissioner for Housing, Moruf Akinderu-Fatai, naim dey break dis news on Tuesday during di 2026 Ministerial Press Briefing wey happen for Alausa, Ikeja.
In fact Akinderu-Fatai rake full newsppaer, say dis money wey dem recover, na just omomo doings and dat dem ready to even do more dat security choke.