Lagos

Lagos Gornment Setup Big ‘Invest Lagos’ Summit To Bring Top Investors

todayJune 8, 2026 5 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State gornment don spread aproko on how dem wan use di third edition of di ‘Invest Lagos Summit’ to bring big investors and correct business opportunities come Lagos and Naija.

Oga Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotosho, naim tuk dis tuk on Sunday, wey pipo dey church, say di two-day event wey start on Monday, June 8,  and end on Tuesday.

Omotosho explain say top gornment leaders, global investors, and big business bosses naim go gather to discuss how dem go take create plenty jobs and expand infrastructure across di state.

Di summit, wey di Ministry of Commerce, Cooperatives, Trade and Investment arrange, go focus on major areas like transport, technology, energy, manufacturing, and tourism.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds