By : Jolayemi Olajide
Seniorman Commissioner for body mata Lagos, Akin Abayomi, don drop advice lagosians, say make everybody look Ebola, eye ball to eye ball, say na smally e be dat mehn gallant dey wait am.
Nor be amebo say Ebola dey scattar some African countries including Dr congo.
Abayomi say dem receive order from above, from Governor Babajide Sanwo-Olu, so dem don set tools to rascal di wicked sickeness wey dey call ebola.
Dis assurance dey come as di sickness don kpai like 177 people out of 700 cases for Congo and Uganda, and World Health Organization don even blow big alarm because of how the mata heavy.