Lagos

Lagos Govt Drag Over 100 Road Median Traders Go Court

todayJuly 2, 2026 5

Background
share close

Lagos State Government don drag more dan 100 pipo go court within di last one year for selling on road medians and breaking environmental laws.

Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one on Wednesday as e supervise operation to flush out illegal traders from di Okokomaiko to Orile road median.

According to di government, di operation na to clear di road once and for all so work fit continue for Lagos Rail Mass Transit project, and to remove every illegal structure wey block di corridor.

Wahab tok say government don warn di traders several times, but demno hear, na im make government bring full enforcement, as dem follow Govo Babajide Sanwo-Olu order.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds