Lagos

Lagos House Of Assembly To Meet Makoko Leaders Over Demolition Wahala

todayFebruary 2, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Di Lagos State House of Assembly don call community leaders wey demolition touch for Makoko and other waterfront areas for meeting.

Clerk of di House, Olalekan Onafeko, ni drop di update for statement, say di meeting na response to petition wey di communities submit about dia eviction.

E say di meeting go hold by 10:00 a.m. on Tuesday, February 3, 2026, for Assembly Complex, Alausa, Ikeja.

Di Clerk say, make community leaders carry all relevant documents wey fit hellep dem, come for di meeting to avoid story wey touch naked wire.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app