By: Mariam Ajayi
Nor be small tin for di past one week for di lagos ibandan express way, as gorment send job men make dem go repair kara bridge.
Say on Tuesday September 15, na mess and handpit smell drivers and passengers wan take kpai dem selfs.
According by wetin some of di road drivers tuk, na one night dem don spend for di road, making dem spend more money for fuel
Nor be only dat one passengers wey dey work sti complain how di hold make dem be like bad pipo to dia office ogas because of lateness, some even get querry letter untop di mata.