Lagos Ibadan Expressway

10 Results / Page 1 of 2

Background

Lagos

Lagos-Ibadan Holdup Make Road Users Lament

By: Mariam Ajayi Nor be small tin for di past one week for di lagos ibandan express way, as gorment send job men make dem go repair kara bridge. Say on Tuesday September 15, na mess and handpit smell drivers and passengers wan take kpai dem selfs. According by wetin some of di road drivers tuk, na one night dem don spend for di road, making dem spend more money […]

todaySeptember 16, 2026 9

Lagos

Truck Kill Man For Lagos-Ibadan Expressway, Driver Run

One yet-to-be-identified young man die for Lagos-Ibadan Expressway near OPIC bus stop, Ogun State, on Wednesday after speeding truck hit am as e dey cross road. Witness Nojeem say di truck run over di man and di driver run away, while di crash scatter parts of im body for di road and affect traffic. Media toktok person Babatunde Akinbiyi confirm di incident and say some officials and Amotekun Corps move […]

todayAugust 20, 2026 12

Lagos

Jaguda boys Steal 168 Solar Streetlights For Lagos-Ibadan Expressway

By : Kofoworola Olayinka No fewer dan 168 solar streetlights don disappear from Longbridge for Lagos-Ibadan Expressway, with suspected vandals blamed for di theft. Dem streetlights wey gornment install for 2025 to brighten di five-kilometre bridge and improve motorists’ safety for night. Findings show say di lights start disappearing few months after dem install am. During visit to di bridge on Tuesday, several areas dey without street-lighting infrastructure  

todayAugust 13, 2026 7

south west

Accident Block Lagos-Ibadan Expressway As Rescue Team Clear Kara Bridge Scene

By: Esther Daniel Traffic movement don slow down for Lagos-Ibadan Expressway on Wednesday after one  accident happen around Kara Bridge area. Emergency responders begin recovery operation to remove di vehicle wey block part of di road, as motorists face delay while dem dey clear di scene. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) confirm di development through dia official X handle, say vehicles temporarily stop make recovery team fit carry out […]

todayJuly 22, 2026 23

Local

10 Pipo Kpai For Lagos-Ibadan Expressway Askident

By: Yusuf Abuh Nor be small jogolo for Lagos, Ibadan expressway, say one Sunday early mormor askident don kpai 10 pipo, including one pikin, and six others collobi wunjury after one Toyota motor go jamisoke Dangote truck for Sapade Bridge. According to Naija road motoring spirit, FRSC, di truk bin dey reverse for di highway when di Toyoto motor vanvanvan gboai jam di truck. Di tuk, tuk of di for […]

todayJuly 6, 2026 8

Local

FRSC Warn Drivers As Heavy Rain Flood Lagos-Ibadan Expressway

By: Yusuf Abuh Di Federal Road Safety Corps (FRSC) for Ogun State don warn drivers make dem get patience and stop to dey drive face traffic, especially for Lagos-Ibadan Expressway. Na Sector Commander, Oludare Ogunjobi, give dis advice after heavy rain flood di expressway on Tuesday, wey come make some drivers pass one-way and cause heavy traffic jam. Ogunjobi say if drivers dey rush and dey break traffic laws, e […]

todayJuly 1, 2026 19 1

Lagos

How Tanker Block Lagos-Ibadan Expressway Jam On Friday Morning

By: Esther Ayoola Say nor be small hold up for Lagos-Ibadan Expressway on Friday morning, as motors no fit move from Longbridge to Magboro and na so no dey come. According to report, na around 7:30am dis problem start afta one fuel tanker block road near Magboro bridge. Na so pipo dey complain, say e be like say everywhere just stand sti, especially for those wey dey go out of […]

todayApril 10, 2026 22

Lagos

UK Returnee Kpai For Lagos-Ibadan Expressway Askident

By: Esther Ayoola A woman wey just return from United Kingdom come attend wedding for Abeokuta don go kpai for road crash along Lagos-Ibadan Expressway. Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Corps tuk, tuk, Babatunde Akinbiyi ni confirm to tori pipo, say di askident hapun around 6 p.m. on Monday when di white Toyota Camry wey dem take dey travel jam one moving truck. Akinbiyi say di woman kpai on […]

todayMarch 24, 2026 15

National

FRSC: Six Kpai, 23 Injured As Trailer Lose Control For Lagos–Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Say Six pipo ni kpai, while 23 others get wunjury for one road crash wey happen near Four Square Camp for Lagos–Ibadan Expressway. FRSC Public Relations Officer Odunsin Afolabi ni convastae dis one, say di askident  hapun around 11:27 am, and dia rescue team reach di scene in just two minutes. Afolabi Yanyanpu say na one trailer speeding and fatigue, ni cause di crash. Di FRSC tuk […]

todayFebruary 3, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds