By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don bring new cybersecurity guidelines wey go hellep improve digital safety for businesses, gornment offices and pipo wey dey Lagos.
Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso, tuk dis one for statement, say, di policy dey timely, as cyber risks dey increase for Naija every day.
Say di framework go set protection rules and systems wey go help secure online activities as Lagos dey try become strong global digital tech place.
He sti explain say Naija dey lose over 500 million dollars yearly to cybercrime according to NITDA, and na because of dat reason gornment bring di guidelines.