Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area.
According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use carry out robbery.
Adebisi explain say di suspects, Abdullahi Mustapha, Salisu Sannusi and Jamiu Sahidu, dey allegedly rob innocent pipo and bin dey try escape, before police intercept stop dem.
Police say investigation dey go on and Commissioner CP Tijani Fatai say di Command go continue di protection of lives and property and bring offenders to justice.
Written by: News Author
LAGOS CRIME NEWS Lagos Police Command Police Arrest Lagos suspected robbers arrested
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026