By: Esther Ayoola
Say like dis lagos State dey prepare to host one big art exhibition wey dem call “Gregorian Art Exhibition” to honour legendary artist Bruce Onobrakpeya.
Organisers wey be St. Gregory’s College Old Boys Association put for news statement, say di event go bring top dignitaries, traditional rulers and art lovers come together to celebrate am.
Dem also tuk say Nobel laureate Wole Soyinka, Obi of Onitsha Nnaemeka Alfred Achebe, and ex-Ogun governor Gbenga Daniel go attend di opening ceremony, wey dem describe as strictly by invitation.
Di exhibition go hold for Jubilee Hall, Ikoyi, Lagos from April 25 to April 27, 2026, as dem add say di opening go start 11:30 a.m sharp to show how serious di event be.