By: Esther Ayoola
Residents for Ogunbowale, Taiwo and Adegbola streets for Ilasamaja area of Lagos don lament wetin nor good say dia area don turn to kingdom of darkness, and e don dey like dat for one month.
Dia complain be say dis one sef go give criminal opportunate to come rob.
According to dia leaders dat, all di times wey dem go Ikeja Electric office for Okota to ask for update, na only “we dey work on am” dem dey hear, without any clear date when light go come back.
One resident, tuk say dem don try many times but nothing don change, calling on authorities to do di needful.