Speaker of di Lagos State House of Assembly, Mudashiru Ajayi Obasa, don get appointment as Sub-National Representative for di Commonwealth Parliamentary Association African Executive Committee.
Clerk of di House, Barr. Olalekan Onafeko, na im read di letter on di floor of di Assembly in Lagos on tuesday, officially notifying lawmakers say Obasa go serve from 2026 reach 2029.
Di letter tuk say Obasa go start im tenure by attending di 90th Executive Committee wey go hold for Swakopmund, Namibia, to represent African parliaments and promote good governance.
For im remark, Obasa thank im colleagues, advise dem make dem dey put di House first, dey continue to work hard, and shine for Lagos and Nigeria at large.