By: Yusuf Abuh
Rescue work still dey continue afta one three-storey building collapse for Alakija area of Lagos State on Thursday, where at least eight people don die.
Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say dem rescue 26 people alive from di collapse for Old Ojo Road, near Alakija Bus Stop, Satellite Town.
Permanent Secretary of LASEMA, Dr. Olufemi Oke sef don konfam di collapse and say, many emergency agencies dey di area to rescue pipo.
Dat as of 4:20 p.m., eight pipo, including one baby girl, don lose dia life, while rescue operation still dey go on.