By: Esther Ayoola
Mali defence minister Sadio Camara don Kpai like dis, Say jaguda boys bomb car near im house for Kati near Bamako.
Dis sef na di family of di late defence minister naim dey konfamate dis mata, say, even im wife and two grandchildren kpai in di process.
Di attack happen as army dey fight serious battles against jihadist fighters and Tuareg separatist rebels for different cities like Kidal, Gao and other areas.
Di rebels and jihadist groups bin carry out coordinated attacks wey shake di country and put heavy pressure on the military gornment.
Meanwhile, Tuareg rebels tuk say dem don finally agree for Russian forces wey dey support Mali army to withdraw from Kidal.