By : Jolayemi Olajide
Lionel Messi don raise fresh injury fear, after e ask make dem substitute am during Inter Miami match against Philadelphia Union for MLS on Sunday.
Di Argentina captain hold di back of him left leg before comot for the game in the 73rd minute during di rain-soaked match for Miami.
Even though Messi waka comot by himself and enter tunnel without help, fans still dey worry ahead of di World Cup.
Inter Miami coach Guillermo Hoyos later tuk say dem remove Messi just as precaution and no be serious injury matter.