By: Rilwan Agbomeji
Di Nasarawa State Govment don beg lecturers wey dey strike for state tertiary schools, say, make dem stop dia action so negotiation fit continue.
Joint Unions of Nasarawa State Tertiary Institutions (JUNSTI) don enter strike since December 29, 2025 because govment never pay full new minimum wage.
Senior Special Assistant to Govo Abdullahi Sule tuk say di strike fit affect students as schools suppose don resume.
E beg dem make dem suspend di strike make govment fit meet dem for negotiation again.