Naija National Economic Council (NEC) wey Vice Presido Kashim Shettima dey chair, Inside dia 157th virtual meeting, don approve 112 national emergency number.
Say dis one sef go make emergency response faster and remove delay during danger or disaster time.
According to di number two man, di new numbers go hellep people for anywhere for Nigeria get quick response when emergency hapun, anytime and anywhere.