By: Esther Ayoola
Nigerian Education Loan Fund don extend dia application deadline for 2025/2026 school year go February 27, 2026.
According to report, say dem shift am from di original January 31, 2026, to give students more time to submit dia applications.
Untop yarnings with tori pipo, NELFUND Director of Strategic Communications, Oseyemi Oluwatuyi, say, dem wan make sure no eligible student miss di chance.
Untop di joinbodi conference, Di Managing Director, Akintunde Sawyerr, add  tuks, say the extension show how NELFUND dey serious about making education available  for everybody.