By: Adekunle Damilola
Nor be small shocky shocky for Naija football space, like dis na NFF give senior man, former Super Eagles coach, Augustine Eguavoen AKA Cerezo, say make im go role with di babes as interim coach of di Super Falcons so dat dem go focus on dia 2028 Olympic Games qualifiers.
Say na Cerezo go train di senior girls as dem dey prepare to face Comoros for di second-round qualifiers dis coming October, while dem still dey search for permanent coach.
Di one wey go burst ya bololo na when dem tuk say di man get experience, reminding everybody how e bin lead Super Eagles carry bronze medal for 2006 Africa Cup of Nations inside Egypt.
Nor be only dat one oh, to make di bench strong, Nasarawa Amazons boss Christopher Danjuma go stand as Eguavoen assistant, a man wey load with women football experience after leading Falconets to di 2024 U-20 Women’s World Cup.