By: Esther Ayoola
Naija Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) say dem wan do small wi nor go gree, wi nor go gree movement on February 3 to support Joint Union Action Committee (JUAC).
Dem tuk am for joint statement wey Benson Upah of NLC and Nuhu Toro of TUC sign for Abuja.
Di rally na to support strike wey workers dey for Abuja based on say gornment never pay dem salary.
JUAC don start indefinite strike since January 19, and di strike don make many gornment offices for Abuja, including FCTA Secretariat and FCDA, close down.