OBODO NAIJA

NNPC Target Over 600 Trillion Cubic Feet Gas Reserve

todaySeptember 15, 2026 1

Background
share close

By: Mariam Ajayi

NNPCL don tok say e wan turn Naija to major gas hub for di world, using plenty gas take boost industry and export.

NNPC Executive Vice President for Gas, Power and New Energy, Olalekan Ogunleye, tok dis one yesterday, Monday, September 14, 2026, for di 2026 Gas Technology and Exhibition Conference, GASTECH, for Bangkok, Thailand.

Ogunleye say Nigeria get over 215 trillion cubic feet of proven gas reserves, and di country dey use am to support local industries and expand gas export.

E add say NNPC dey carry out Gas Master Plan wey go help move Naija gas reserves from 215 trillion cubic feet to over 600 trillion cubic feet, stressing say gas development and monetisation na business wey suppose bring money.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds