By: Esther Ayoola
Oga Minister of di Federal capital Territory, Nyesom Wike don blast Peter Obi say im no get beta leadership to handle anything.
Di FCT minister yarn dis one on Sunday for PDP 2026 convention wey dem hold for Moshood Abiola National Stadium.
E say Obi waka comot from Labour Party when gbege start, instead of solving di problem, say dat move nor be smart move at all.
Wike say Obi oh and all PDP govos, wey join oda Parties because of party wahala, say all of dem nor be beta leaders, cause dem nor fit stand pressure.