By: Yusuf Abuh
Senior man, Oba of Lagos, Rilwan Akiolu, don wire beta SMS ehn, give Lagos State Gornment say make dem shine dia eyes and support traditional rulers for di obodo Lagos.
Oba Akiolu make di call on Sunday inside im 23rd anniversary for di throne.
Di monarch say while many traditional rulers and chiefs dey ensure say things dey go well, some bad ones don turn land grabbing, thief, thief pipo land up and down, say dem don turn am to business.
He warn say gornment support go help prevent land grabbing and protect di interest of di people.