Lagos

Oba Of Ketu Call Out Ikosi King And LCDA Chair Over Disputed NIPOST Land

todayApril 14, 2026 4

Background
share close

Unto updates for Kosofe area of Lagos, Oba of Ketu, Isiaka Oyero, don fault di building of a palace for disputed land wey dey Ikosi-Isheri LCDA.

E explain say di land na one-acre wey Oyero family donate give Nigerian Postal Service for 1980, make dem build post office, na why, di mata sti dey court.

Oba Oyero accuse Oba of Ikosi, Alamu Oloyede Onikosi, and Ikosi-Isheri LCDA chairperson Samiat Bada, say dem sti dey continue construction for di land despite ongoing court case.

But Onikosi and Bada don deny di claim, tuk say di palace project na lawful work wey dem dey carry out properly.

Written by: News Author

Rate it

Similar posts

Lagos

Man Chop Life Jail After Sexual Assault On 6-Month-Old Pikin For Lagos Court

Justice Rahman Oshodi for Ikeja Sexual Offences and Domestic Violence Court don sentence one man, Victor Dickson, to life imprisonment, sake of say, e rape im neighbour 6-month-old pikin. Di judge tuk say prosecution show strong evidence wey prove di sexual assault case, pass reasonable doubt. Court also say, all […]

todayApril 14, 2026 4

Lagos

Lagos Police Clear False Alarm Say Area Dey Free From Cult Operations

Lagos State Police Command don clear air on di rumour wey fly say cultist wan test dia power for Shitta, Akerele, Itire/Aguda and Ishaga  area, say di report na false alarm. Dis one di police put for statement wey di police tuk tuk person, PRO Abimbola Adebisi release to tori […]

todayApril 13, 2026 2


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app