By: Esther Ayoola
Residents for Ogun State don come out for Abeokuta streets do wey nor go gree sake of insecurity and di kidnapping of 39 school children plus seven teachers for Ogbomoso, Oyo State.
Di protesters, wey include youths and nursing mothers, carry placards dey demand make gornment act fast to rescue di victims and stop kidnapping, banditry and terrorism.
Dem say na children wey nor commit any crime, na some anyhow jaguda boys carry and dat im nor make brain at all.
Di protest come afta gunmen attack three schools for Oriire Local Government Area on May 16 and carry away dozens of pupils and teachers.